From Enugu to Aba, Everybody Dey Ask #WhatsInTheBag?Something big dey shake social media, and if you never hear am, you never dey online!
From Enugu to Owerri, Aba to Onitsha, everybody dey watch TikTok and Instagram dey wonder the same thing, #WhatsInTheBag?
For days now, videos dey circulate where people dey open bags but no dey show wetin dey inside.
Na big question full the comment section, wetin dem dey hide?
Some talk say e be one new product launch, others dey guess say na something cultural. But no matter the theory, e clear say the thing wey dey come no be small.
As e be now, the whole East don lock in, dey wait for the bag to finally open. But until then, na to dey watch, dey guess, and dey gist!!!
You don see any of the videos? Make you no dull. Join the trend online, drop your own guess, and tag am with #WhatsInTheBag.